NIN change of birth

Wia dis foto come from, NIMC

National Identity Management commission say Nigerians now fit correct dia date of birth by themselves.

NIMC announce dis new update for dia social media platforms.

Di National Identification Number (NIN) na wetin Nigeria goment dey use establish di identity of every Nigerian.

NIN get 11 non-intelligible numbers wey dey randomly chosen and assigned to one individual once dem finish dia enrolment for di National Identity Database (NIDB).

Dis na eviritin you need to know about how to change date of birth by yourself for NIN.

Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading

Di one wey oda users dey read well well

  • Education Minister Siviwe Gwarube wear one white top as she dey tok for one official event

  • Dem pour out votes for table from one ballot box

  • Foto mix of McTominay [Napoli] Dembele [PSG] Rashford [Barcelona] di big scorers on Tuesday night

  • Regina Daniels during interview with BBC News Pidgin

End of Di one wey oda users dey read well well

Date of Birth Self-Service Modification steps for NIN

Afta pesin enrol and collect dia NIN minors and adults alike fit update dia details for dia NIN.

Tins like Name, dates of birth, addresses, etc. fit dey modified. But di date of birth na only once you fit correct am.

Once you open di website next tin to do na to follow dis steps

  • To begin you go need verify your NIN and log in.
  • For your dashboard select di date of birth modification option.
  • Complete di payment for di modification securely via Paystack.
  • Afta you pay, put your NPC certificate number and validate am. Your date of birth go automatically dey filled and e dey non-editable. If you don misplace your birth certificate, do di birth attestation online for http://nationalpopulation.org.ng.
  • Upload your NPC certificate along wit any required supporting documents.
  • Submit your modification request and preview di adjustments.
  • Make sure say you check di attestation box before you submit your request.
  • Collect your modification transaction slip promptly for di modification table.
  • Once e dey approved, you go receive notification, and dem go send your NIN slip to your email. You also get option to print di slip directly from your dashboard.

Wit your device you fit do your NIN modification through di self-service on dia website anytime and anywhere

How much to correct Date of birth for NIN?

Di National Identity Management Commission (NIMC) say Nigerians wey wish to correct dia date of birth for dia National Identification Number go pay N16,340.

While to change Name na – N1,522.50 for Address na – N1,522.50 and Email na– N1 522.50

Supporting Documents for Data Modification

Change of Name

  • Sworn Affidavit
  • Newspaper Extract
  • Marriage Certificate (in cases of marriage)

Change of Address

  • Utility Bill
  • Tenancy Agreement
  • Bank Statement
  • Community leader Attestation

Phone Number due to loss or mechanical damage

Police Report

Level of Education

Change of Occupation